+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Omotola Jalade Husband Nor Buy Motor For Me oo — Destiny Etiko

Actress Destiny Etiko don enta dragging for one TikTok blogger hand afta di blogger say di actress dey follow Omotola Jalade Ekeinde husband sotay di man but new motor for Etiko.

Di blogger karey full chest say Matthew Ekeinde wey be pilot nai buy di new expensive motor wey Etiko dey use.

But for Instagram live video nai Etiko say na bad belle dey make pipo spoil her image , cus she don work ve y hard but upon go still dey karey her name waka for bad.

She say even di pinsure wey pipo dey tok, na four years back she snap am with Omotola husband afta di plane she enta na Mr Ekeinde nai drive am and pipo set sef come out to snap with her.

Nai she come dey ask weda men still dey give women moni cus for her she nor know as her moni na work she dey work am.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM