+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Ondo AMOTEKUN Don Arrest 39 Bandits Wey Dey Run From US Strike

Place don dey hot for some of di bandits and terrorists afta di airstrike wey United States military, use take dash dem on Christmas day for north, cus some of dem don dey run go some oda states.

Di commander of Ondo State Security Network Agency, Akogun Adetunji Adeleye say dem arrest 100 criminal and 39 inside na bandits wey dey run from north.

Na way AMOTEKUN dey parade 61 of di suspects nai dem take bring di 39 for dem headkwatas for Akure.

Adeleye come say Ondo nor go give dem chance cus dem don put tins in place to make sure say di state too hot for any terrorist or bandit.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM