+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Onyeka Onwenu Burial Go Be Dis Month – Family

Singer Onyeka Onwenu wey don die family members don say e nor go pass dis month end nai dem go bury her.

Na during sorry nor cry again visit wey Musical Society of Nigeria, MCSN, gada go greet di family for di singer house for Ikoyi, Lagos, nai dem take tok am.

Di children wey be Abraham and Tijani say few days from now dem go announce di burial arrangements to sharply bury dem mama.

Na for 2021 nai Onyeka take do interview tok about as dem go mourn and bury her when she die. Say make dem nor do big burial or cry too much, make pipo laugh and remember her for good.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM