+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Oro Festival Jam August 1st Protest For Lagos State

August 1st don dey near and naso Nigeria youths dey mind dey ready for di protest of #EndbadGovt wey dem wan do but juju pipo for Lagos don come up with anoda plan for that day.

Di pipo wey dey do Oro festival send notice to Lagos State pipo and any visitor wey dey dey land make dem know say for di whole state dem don plan to do dem festival from that same August 1st till August 15th.

As pipo hear am nai dem start complain say na went hapun for 2023 election wey Oro come do festival di day of election nai dem wan do again but di state govimet don say na lie dem hand nor dey inside.

Throu di mouth of di Special Adviser on Media and Publicity, Gboyega Akosile, nai Govinor Sanwolu say he hand nor dey inside.

Akosile tok say di juju pipo get right to di dem festival and just di way youth wan protest #EndBadGovt but make everybodi know dem lane so that gbege nor go come out.

Cus police go tanda for ground to make sure say everywhere clear but if di protest wan turn eye dem go hold ground make blood nor drop.

Even sef some state govinors don dey tok, do meeting with dem youth to put di protest for pocket.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM