+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Over 60 Pipo Nai Dam Water Don Kill For Sudan

E don pass 60 pipo wey dem say don die for Sudan afta heavy rain finish one dam down.

Village, farm, motor cars nai di flood from Dam Arbat wey dey for Red Sea State don wash go out for one side.

Di Dam sef nai be one source wey pipo for Port Sudan take dey drink water and na there nai di military govimet headkwata even dey.

Currently rescue team dey find pipo and fear dey up say be like plenty pesin don die cus most villages no get means of communication again as di flood don scatter tins.

Some of di community pipo dey say many house water don karey am go then some sef dey trap inside dem motor.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM