+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Papa Summon JAMB To Senate As Dem Nor Release Pikin Result

One man Onyebuchi Obioha don drag Joint Admission and Matriculation Board, JAMB, go meet Senate say dem nor gree bring out he dauta result.

Di papa of 16 years Chizitere Audrey Obioha say make Senate do beta investigation for di mata cus as dem dem look am wayo full inside wey JAMB dey hide.

Na tru Senator Neda Imasuen, nai di papa take send di petition give Senate and dem say for di exam hall one supervisor say he like di daugta give her number for paper for call but di pikin show he papa. As dem call di nuba dey warn am nai he change level say na wrong nuba.

Dem say JAMB dey tok say na wayo Chizitere dey for hall, dem don do panel and all but still yet noting to show say di pikin do way and JAMB nor still one bring di result.

Nai Mr Obioha say make dem force JAMB to show evidence from CCTV wey dey di center and any other material m, then if dem pikin do bad dem go manage am like that.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM