Di tok wey United States President, Donald Trump tok say na paracetamol nai dey make children dey get autism come from belle, di World Health Organization don say not be true.
Health researchers publish one report on Monday say all di shout wey Trump dey do upandan to make pregnant women fear, nor karey water and na only to make pipo wey get autism to dey feel more bad.
Dem say no link of paracetamol to disease afta Trump don bin dey shout for September say make pipo shine eye as di resin wey make autism dey spread like wild fire na from painkillers.
