+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Passport Increase To N50k and N100k

Di price wey pesin go take get Nigeria passport now don rise like ijegbu garri as Federal Govimet don say na new price pipo go dey use take get am now.

Na KT Udo wey be di tokpesin of Nigeria Immigration Service nai tok on Wednesday say price don go up but di new price nor go touch pipo wey dey for outside Nigeria as na still di old price dem go pay.

Di statement say why govimet increase di price na to make sure say Nigerian passport get beta integrity and standard.

Dis new price na from 1st of September e go start dis year, that one be say 32 pages wey be 5 years, now go be N50,000 now instead of di 35k wey e dey bifor.

While di one for 10 years wey he 64 pages dem karey am from 70k to 100k.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM