+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Pastor Chris To Church Members, We Go Build Anoda bigger Church

Fire burn di headkwatas of Love World International aka Christ Embassy wey dey for Oregun, Ikeja for Lagos State early mormor on Sunday and di fire finish di building.

Why some of di church members dey tok about di fire, dem say na spiritual cus even till now di cause of fire never clear then some say na electric spark cause am.

Na 7:00 for morning nai di fire start and e burn till 3:10 for evening bifor dem finally off am but wey di fire dey go on di church pipo dey for Asese, dem crusade ground along Lagos/Ibadan express where dem take go do thanksgiving service of dem one week program.

According to one church member wey be Chinonso, he say na for social media dem take see as their church dey burn cus all of dem go for thanksgiving and nai make God even save dem from death.

Right now di Lagos State govimet say dem go do some check for di building case di fire don already crack di church walls.

Di founder and president of di church, Reverend Chris Oyakhilome, say make he members nor worry since God don protect all of dem, dem go build beta structure wey fine pass di one fire burn.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM