Senior pastor Paul Adefarasin of House on di Rock Church, don karey hinsef go meet police cus dem say he point sumtin like gun for one man.
On June 6, 2025, nai one guy see motor start to video am, naso pastor whinde down warn di guy make he nor try am film am again di guy come dey beg.
Afta di video trend online nai di pastor say he nor use any gun face di guy wey video am.
Na cus of di mata nai make Lagos State Police tokpesin Benjamin Hundeyin say “No bodi big pass di law and dem don invite Pastor Paul Adefarasin to dem headkwatas make he come tok why he karey wetin be like gun dey point pesin and dey even drive motor wey nor dey registered.
Police come say dem go update pipo about how di investigation dey go.