+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Pesin Tiff Teree Days Baby For Cameroon

No be small mata hapun on 3 of August for Cameroon as a new born baby wey dem just born lost for one Ekoundom Baptist Hospital for Yaoundé di capital city.

Dem say na di hospital maternity ward nai dem take see di teree days old baby wey one staff dey take care of her but afta 7:30 for evening dem nor see di pikin again.

Di baby girl papa and mama don dey beg say dem go pay any moni to get dem pikin back.

Tension sef don dey rise for di community as pipo don dey block major roads dey ask di hospital to tok truth for di mata cus dem no dey vigilante at all.

Even Authorities dey ask say any information wey dey needed make pipo dey tok come even bring out nuba wey dem fit take reach dem.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM