+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Pilot Wey Dey Fly Turkey Areoplane Die For Air

One pilot wey dey work with Turkish Airline, Ilcehin Pehlivan nai dem say he die for plane as he dey fly pipo from Seattle dey go Istanbul on Tuesday evening.

Di 59 years man dey with he co pilot and nai so di second pilot sharply call for quick landing wey dem do for New York, according to di tokpesin of Turkish Airline, Yahya Ustun.

Dem say bifor dem land dem try their best to give di man first aid but he nor fit so anytin as di pilot die bifor dem even reach ground.

Info say di Pehlivan don dey work with di Airline since 2007 and just March here he do test wey show say he nor get any healt problem.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM