Singer Temilade Openiyi wey everybodi know as Tems nai don win di 2015 edition of Grammy Award wey dem so on Sunday.
Di song wey di Tems take tear everywhere na di “Love me jeje” single and na wetin dust Burna Boy, Chris Brown & Davido, Asake, Yemi Alade, join with plenty odas.
As di singer don win di Best African Music Performance naso different pipo dey congratulate her as e nor easy.
Even sef Peter Obi foma Govinor of Anambra State don throwaway salute for her and odas, say e nor easy as all of dem dey make Nigeria proud so tay dem karey shoulder like who get boil for armpit.