+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Pipo know Say Bwala Lie Dey Sink Shark For Sea- APC Seniorman Osinowo

Di misyarning wey Daniel Bwala, presidential aide of President Bola Tinubu, go tok with journalist Hassan of Al Jazeera for United Kingdom nor be small insult pipo don use baff am, even chieftain of APC, Ibrahim Osinowo, don use heavy stone nack Bwala for head.

Di whole dram start for weekend afta Bwala karey hinsef go interview, Jassan come dey ask am how he take dey say Tinubu govimet bad for 2023 but Bwala say he nor ever tok like dat even with video clip. Then on Saturday nai Bwala say di journalist nor tell am say he go ask dat kind kwetun if not he for prepare come.

But for News Central Television on Monday, di senior man of APC, Osinowo say Bwala dey tok for himself as di only pesin wey fit tok about di govimet outside na di official tokpesin for President Bola Tinubu wey be Bayo Onanuga.

Osinowo come say Bwala wan just wan change tins for hinsef as many pipo know say he be liar and don use bad mouth take scatter President Tinubu bifor.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM