+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Pipo Wey Want Make I Die, Na Jail Una Go Land— Sen. Ned Nwoko

Senator Ned Nwoko wey dey represent Delta North Senatorial District for National Assembly don say di bad story wey dey waka upandan say hin die for Switzerland na wetin he nor go take again.

He say he nor fit dey alive make pipo dey dig grace put am cus of say he go buy motor give Aunty Success of Mark Angel Comedy.

On Friday nai di Senator wey be Regina Daniels husband say enough don do for bad tok, any pesin wey dey wish am bad must land for prison.

He say di jole don too much and that bad mouth curse for am na lawyer he go use fire pipo wey tok, cus nor be mata of say na big man oppress poor man but he nor fit sitdon make pesin dey curse am.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM