+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Arrest Fake Superintendent Wey Nor Gree Go On Transfer

Police don arrest officer Buba Adamu wey dey for Cross Rivers State cus hin don dey parade hinsef as superintendent of police and dey use am commit different kind of crime.

Adamu real position na corporal and dey serve for Calabar till dem transfer am for 2015 to Kaduna State but he nor gree go but start to dey parade hinsef as senior officer.

He don dey use di uniform and rank of SP to carry out illegal activities for di state until pipo come go complain about am to police command.

Wetin di Police Public Relations Officer of Cross Rivers, SP Irene Ugbo, tok say na pipo around Bacoco, Nassarawa area wey Hausa/Fulani dey stay nai come report to dem say dem don tire to sufa and smile for Adamu hand.

Dem say Adamu don dey kolet he monthly salary since that 2015 but he nor get any particular station wey he dey report to.

But as dem don catch am now, na investigation police dey do to see all di crimes afta them na to slam am punished.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM