+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Arrest Girl Wey Plan To Rob Her Boyfriend For Warri

Police don arrest Jessica Anthony, one girl wey go plan with arm robbas make dem go tif 7million from di boyfriend make she use am take pay her sista hospital bill.

Jessica na just 24 years wey waka go meet some bad boys for Warri come dey tell dem her plan say she want make dem go tiff from di boyfriend, but one of di bad boys know di boyfriend and just folow plan like say he nor know anytin.

As dem dey make di plan dey go di friend of di boyfriend come go tell police, naso hand take touch Jessica.

As SP Bright Edafe dey ask Jessica why she do wetin she do, she say na cus she need moni to pay for her sista hospital bill wey be 7m and just want make di robbers tiff di boyfriend gold.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM