+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Arrest Keke Man Wife Wey Cut Husband Manhood For Zaria

Zaria Police for Kaduna State don arrest one woman wey her name na Habib Ibrahim cus she go cut her husband gbola.

Di resin wey make di wife cut di gbola nor bodi know but wetin di 40 years husband Salisu Idris tok be say he just lie down for bed afta he come back from early morning prayer nai di wife just jump ontop of am with sharp knife cut hin manhood.

Idris say na keke he dey drive and di epp of hole neighbor nai dem take quick rush am to di first hospital if not di wife for cut di gbola finish.

Di man say he still dey wonder wetin enta he wife bodi wey she take go cut am like that cus since dem marry for four years dem never quarel. And as he dey now di only tin wey dey he mind now na make he well first.

For Ahmadu Bello University Teaching Hospital wey he take dey take treatment, Idris mama wey dey take care of am say di pikin nor ever complain for am say he dey get problem with Habib.

Mama Idris say even di tin dey surprise Habib family, as na dem even wan pay for her pikin hospital bill.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM