+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Arrest Pipo Wey Produce Russian Flag For Protest

All di pipo wey dey karey Russian flag take dey do protest for Northern Nigeria, President Bola Tinubu don say make dem hold dem down.

Wey dem finish di National Security Council meeting nai Gen. Christopher Musa di Chief of Defence Staff, tell state house tori pipo say di gbege wey dey di protest too much and dem get to stop am as jaguda don take over.

Na di move make presidency and army to give strong warning that any pesin wey karey anoda flag for Nigeria dem go treat am as terrorists cus na bad tin against di knotri.

Afta di tok nai security don catch 31 pipo from Kaduna and Kano wey dey produce and distribute di Russia flag.

ACP Muyiwa Adejobi, say 30 of dem nai dem catch for Kaduna wey dey produce di flag then 1 na for Kano and na him dey distribute am give pipo.

Even sef, Russian Embassy for Nigeria say dem Govimet hand nor dey for that kind move wey dey go on for Nigeria.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM