Hand don touch one Micheal Ezenwani wey run from Oko prison during #EndSARS 2020 protest, come dey comit havoc for Agbor.
Na on October 24 nai hand touch am wey Ezenwani dey try to sell one phone, but pipo come call di DPO of Agbor as di tiff dey lie say he bring di phone from Libya.
As dem still dey on di case nai di phone ring, di pesin say na her sista, Christabel Egedefe nai get di phone.
According to SP Bright Edafe on Wednesday he say di DPO and he team come go Christabel haux only to see her deadi bodi for ground, na there nai Ezenwani come confess say na he kill di 26 years lady and na her papa send am.
Later again, nai di suspect change mouth say he just wan drag di papa name for di mata as di man no know anytin, na only di tiff go Christabel haux on October 23, 2025, come kill her wey she dey struggle di bike key with her, bifor he tiff di phone.
Police come know through dem investigation say Ezenwani na heavy killer wey he hand don dey for some kind bad cases bifor.
