+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Arrest Tiff For Warri, Ughelli and Sapele

Police hand don touch tiff for Warri, Ughelli and Sapele wey dey disturb di area afta operation wey di special assignment team of di CP lead.

Di one wey officer Julius Robinson lead on February 27, 2026, around 11:35, dem emta Ekredjebor for Ughelli naso hand take touch OgheneMaro Festus wey det stay for Upper Agbarho and he own na to dey enta pupo haux dey rob dem. Police eve see one pump action from am but he oda gang dem run.

While for Sapele pipo don dey complain say di okada pesin dey tiff dem and hand dey point to 21 years Prince Omanure wey pipo deh call Anini. For March 1 nai hand touch am for Ghana Sapele, bifor he come karey police go one bush wey dey Warri-Sapele Road near Trailer Park, na there dem see one Beretta pistol with eight live bullet.

From there police get info say some cult boys wan cus problem for Okwagbe Street inside Igbudu. on February 27th nai hand touch Nelson Mudiagha aka Diara, Efe Nyore, and Ebube Ifeanyi.

Di three of dem say dem by Aye members and dem see one double barrel gun and 17 live cartridge.

Police say na court dem go see demsef afta investigation finish cus di oda tiff wey run, police dey find dem.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM