+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Catch Kidnapers For Upper-Agbarho

Delta State Police Command don use gun take porchu some kidnapers komot from Upper-Agbarho for Ughellli and around afta two die ontop.

‎Na on Monday nai SP Bright Edafe di tokpesin of police say two of di kidnaper die while two policemen still dey hospital.

‎Dem say na how to komot kidnaper for di area make ASP Julius Robinson and he team find one Abubakar Musa wey be 28 yrs and come from Ajase town, wey dey for Irepodun LGA, Kwara State, but he dey stay for Abajo area for Port Harcourt, and Yusuf Sale, 25 yrs from Rimin-Zayam town wey dey for Toro LGA, Bauchi State, and dey stay for New Owerri inside Owerri.

‎As hand touch di two nai dem lead di team to one bush wey dey beween Upper-Agbarho and Oviri–Ogor Communities, na there police take see one AK-47 with two magazines and forty-three rounds of live bullet, one pump-action shotgun, and local pistol.

‎Di operatives dey come out from di bush wey oda members of di fans waylay dem to free di two gang with police, naso shooting start, sotay di gang members wound and two police still wound join.

‎As di Kidnapers see say water don pass garri nai dem run but police dey find di rest as di oda two die for hospital.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM