Police see bomb for Bayelsa State Secretariat Complex on Wednesday around 6:00 for morning, but di team quickly stop am mame e nor bomb scatter di state.
Tokpesin of Bayelsa State Police Command, DSP Musa Muhammed, confam say wey dem reach there dem catch one 60 yrs man, Pentecost Elijah, for where di bomb take hapun and he na native of Otuan Community for Southern Ijaw LGA, Bayelsa.
Wey police reach there di Explosive Ordinance Unit come quickly komot di bomb and as dem dey aearch di area dem see anoda bomb wey never blow .
Police sha say not bodi kpai, no property burn but dem don start investigation on di mara and afta that na court di suspect go reach.
