+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Don Arrest Canada Woman Wey Wan Kill Yoruba and Bini Pipo

Di 46 years woman wey dey stay for Canada but na Nigeria pesin, Amaka Sunnberger, wey her tok make House of Representatives and Nigerian pipo for obodo oyibo about say she go kill Yoruba and bini, police don arrested her.

For one video wey waka for August 25, 2024, for social media, one woman wey dey provocate say make Igbo pipo wake up gada demsef kill any Yoruba or bini pesin wey near dem cus dem too do, di word come even make Abike Dabire-Erewa, Chairman, Nigeria in Diaspora go dig di woman information come out.

Naso House of Representatives come send letter go give Canada govimet to arrest and punish di woman but Amaka come say Canada nor go arrest her or even send her back to Nigeria.

But be like mata don turn as yesterday for Toronto nai Toronto Police Service arrest Amaka and today she dey go face judge of Ontario Court of Justice today Monday, wey be 2nd of September.

Di Toronto Police Hate Crime Unit say dem dey do investigation for wetin Amaka tok.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM