+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Don Arrest Flogging Children Pastor For PH

‎Di 41 years pastor from Eneka Port Harcourt, Ifediorah Onyeibor Joseph, wey he video waka as he dey flog some small children, police don catch am.

‎Di pastor dey flog more than 20 children for di video and some nor wear cloth while dem hold palm frond for dem hand dey cry.

‎Peain wey post di video online say for days now naso cry di children dey cry for nite and dem never chop.

‎Wey police come go di church nai dem catch di pastor and some other church members, dem don even start to investigate di mata.

‎Wetin Rivers State Police tokpesin Grace Iringe-Koko tok be say di pastor say na 3-day spiritual cleaning program nai he dey do for di children cus na Holy Spirit nai tell am to do so.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM