Skool principal don karey 13 years girl go meet police to deal with di 32 years step fada wey give her belle come even wan remove am after he don dey sleep with her even bifor her period start
As di mata reach police hand nai dem go arrest di step fada cus di principal say she dey see changes for di girl bodi, bifor she come open up say di papa don buy drugs wey she go use clean her system.
Delta State Police Public Relation Officer, SP. Bright Edafe for video say na drugs wey di papa go check online nai he buy for pharmacy give di small girl and as di period nor still come he come buy injection wey dem dey dey give thru vein, tell di pikin to drink am.
Di man don dey police hand and hand don touch di pharmacy wey sell drugs without prescription.
