Di nuba one organizer of sucide bombing for North East police don catch am on 31st of December 2025 afta dem raid Kalmari area for Maiduguri plus 14 suspects wey dey folow bomb places.
Na Joint Task Force for North East ‘Operation HADIN KAI’ (OPHK) nai catch Shariff Umar and di rest pipo wey dem get information on were di group dey hide.
Statement wey di Media Information Officer, Lt. Col. Sani Uba release nai open how Shariff Umar aka Yusuf dey operate, how he take dey recurite and organize boys for suicide bombing.
How di police take know say Umar nai be di organizer na wey Ibrahim Muhammad see come say nai be dem ring leader and na him and organize di bombing wey hapun for Gamboru Market Mosque on 24 December 2025, but he second Adamu die with di bomb vest.
