Delta State police don rescue one five-month-old baby wen dem thief two months ago for uvwie local government area.
The state police commissioner, Olufemi Abaniwonda nai talk this one for one press briefing for Asaba say one 49 year woman , Joy Temitope Oyetimi nai theif the pikin for February.
The mama of the pikin con talk how the suspect drug am when she dey travel from Koko to Warri.