+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Find Kwale CDC Chairmo Deadi Bodi For Junction

As fight don bin dey go on for two months for Obodougwa-Ogume community wey dey for Ndokwa West LGA of Delta State cus of who to be di leader, case don worwor for di foma Community Development Committee, CDC, Chairman, Anselm Oyibo cus dem just see e deadi bodi for Kwale junction.

Tori wey drop be say some pipo cut Oyibo bodi come burn am join with he Okada for along Kwale-Obiaruku Road.

Pipo wey dey close to Oyibo say na on Sunday around 11:30 for nite as he dey sleep nai he just jump from bed karey phone, where you dey go Oyibo, be say he deg come back now now.

As he say make dem open gate, Oyibo karey he Okada come dey call one pesin, since he gets two wives dem feel say he dey go di other wife house.

But morning reach he nor near house, dem call tire nuba stop to ring, wey dem ask di second wife she say she nor karey eye see her husband. Na later nai info come say dem cut and burn pesin with Okada for junction.

Delta State Police Command through dem Public Relations Officer, Mr. Bright Edafe confam di mata and say dem dey do investigation.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM