+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police For Abraka Shoot Girl Afta Boyfriend Nor Gree Stop For Dem

Tension dey for pipo mind wey dey stay for Oria-Abraka community afta police of Abraka Division go shoot one girl for di community come run leave her on Saturday.

Di girl name wey di policemen shoot na Rukevwe John, and she dey between life and death for one hospital afta police aim her boyfriend motor for front of Oria-Abraka secondary skool.

Na Sunday nai one group Initiative for Social Rights Concerns and Advancements, ISRCA, say make Delta State Commissioner of Police, Surajudeen Olufemi Abaniwonda, come out mouth for di case to investigate di whole tin cus he nor go funny say dem allow di policemen wey match ine go free.

Wey di Rukevwe boyfriend, Precious dey tok wetin hapun, hin say as he dey turn for bend to enta di other side of di road, nai he just hear big nack for he moto. Come down see say na police do am, tell am to come down, with di vex nai Precious enta motor leave police.

As he dey drive dey go, nai Precious hear gunshot for di back of di motor pass enta hit di girlfriend wey sitdon fo front.

ISRCA National Coordinator, Comrade Derrick Oritsematosan Agberen, tok for statement say he don bin reach out to Abraka DPO, SP Fabian Ayameh and the PPRO, DSP Bright Edafe bifor he come dey call on CP of di state.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM