+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police For Rivers State Warn Against Gbege As Protest Get Kleg

Mind dey grow for di protest for Rivers State and some area don dey get small problem wey dey wan rise.

Di tokpesin of di Police State Command, SP Grace Iringe-Koko, don dey hammer say dem nor dey see di organizers of who dey coordinate di protest as everytin just dey yangayanga.

Bifor now di police back chest to protect protesters but music don change cus dem say tins dey turn upside for some area.

Di Police all di bad behavior of pipo dey burn tyre, kolet moni from drivers hand, dey block road, scatter pipo motor and other bad tins nai dem nor go take.

Iringe-Koko still say one group don tok say August 7th go bad for di state and make nor bodi open dem business place or dem beta folow join di protest.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM