+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Inspector For Adamawa Delete Hinsef Cus Of Hardship

One olokpa wey dey with Doubeli Division for Adamawa State, Dasu Kassa, nai don go kill hesef for he house afta he come back from hospital.

Bifor di inspector die, he dey work as driver for he police station, but on Monday evening dem see he deadi bodi for outside he house for Anguwan Yungur, Girei Local Govimet Area.

Wetin di neighbors around tok be say, he just come back from hospital from di state capital, Yola, but bifor day go dark di man do kill hinsef.

Police don dey do investigation on why Kassa go kpuftalize hinsef. While di family members deh say na money mata and as tins hard e nor get money to pay hospital bill nai fit cus Kassa to commit sucide.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM