+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Kill Kidnaper For Inene Inside Ughelli

To make sure say pipo nor dey run upandan, dey sleep with close eyes for Delta State, di Commisoner of Police, CP Abaniwonda Olufemi team wey he send go Ughelli don down one kidnaper for Inene.

With information wey police get nai dem take bust enta Inene community for Ughelli take go arrest Joseph Joel, as hin see police nai he start to shoot then police shoot back.

With wetin di tokpesin of di command, DSP Bright Edafe tok on Monday for Asaba, dem rush Joel go General Hospital afta cus of di wound wey he gets from di shooting but he nor fit make am alive.

He say dem see AK-47 gun wey full with bullet and now di gang members don dey run but di police say dem dey find the ones wey run.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM