One kidnaper wey police karey go hospital nai dokitors confam say don kpuf cus of gun wey touch am for shooting battle.
Wetin Delta State Police Command tokpesin, SP Bright Edafe, tok be say wey dem get di info,nai CP Special Assignment Team enta Ohoror community for Ughelli-Patani Road, but as di kidnaper see dem nai dem start to shoot naso di gun fight take start.
As dem dey shoot, gun come touch one of di kidnaped wey come die but di oda one run as police still dey find am.
As police find di place, dem see one K-2 rifle, two local guns, live bullets qey dem tie inside bag.
