+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Nor Shoot Anybodi For PH– Rivers PPRO

Di video wey dey waka upandan for social media wey police dey shoot anyhow for Port Harcourt Secretariat all to put fear for di pipo wey karey protest say make di Local Govimet Chairmen wey dem tenure don expire komot from seat.

Di State Police Command don say notin like that hapun as nor police shoot any Ijaw youths for di protest.

Grace Iringe-Koko the Rivers Public Relations Officer say make pipo nor dey karey tok wetin dem nor know cause police dey ground to carry law and order for di state.

But one pesin wey say hin na one of di leader for Port Harcourt City youths, Ichemanti, say police just dey karey shoot and di gunshot even touch one of dem.

Nai di PPRO say make pipo dey watch word wey dem dey karey waka cus karey tok dey put pipo for problem.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM