+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Summon NLC Presido To Ansa Terrorism Financing Kwestun

Nigerian Police headkwata don call Joe Ajearo, NLC Presido make he come tok wetin he know terrorism financing, treason and other bad tins wey dey count for he head.

For statement wey di police signed thru di Assistant Commissioner of Police, ACP Adamu S. Muazu, dem say make Ajearo report for IRT complex for Abuja by 10:00 on Tuesday morning, August 20, 2024.

Police say make NLC Presido show he sef for that time wey dem give or police go use arrest warrant take go pick am up.

Know bifor now NLC tok during di hunger protest say police go dem headkwata fo dey scatter tins and even tiff documents and some other important tins.

But police say nor be true at dem just find one suspect reach di building and as e come be na di same place wey NLC office dey, cus dem own na to get some documents wey #EndbadGovernace pipo take dey cus trouble.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM