Policemen don take over di Peoples Democratic Party Secretariat on Monday cus of di National Executive Committee meeting wey dem suppose do today.
Di police enter di seketaria to make sure say di NEC meeting for today nor hold cus di too much tension wey don dey ontop PDP dey increase everyday.
Wetin one official wey dey di party tok be say, some staff enta inside di place but e nor tay nai police tell all of dem to come out and even tori pipo sef, police still drive dem komot from di seketaria.