+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

All Election Petition Case For 36 State Now For Abuja And Lagos –President Of Appeal Court

All di case of di 2023 election wey dem dey judge for tribunal don find leg go Abuja and Lagos.

Na di Court of Appeal president, Justice Monica Dongban-Mensem, nai say from now till dem go judge any case wey remain again, e go either be for Abuja or Lagos.

Dis order wey di president of di court give, go cover di one for govinorship, national and state assembly elections.

Di resin wey make Justice Dongban-Mensem give di order nai cus of say many political parties and dem candidates dey protests say di judges for dem different states for di tribunal dey do wayo judgement cus of too much pressing for dem hand.

Na di too much complain nai come make Dongban-Mensem hide send some pipo make dem go investigate di mata of di govinors and judges for di tribunal weda na really true.

Afta di investigation, everytin clear for white paper say some of di judges and govinors don chop for di same table sotay dem come dey tok from kona of mouth.

Na there dem take catch some of di judges, and dem go soon face trail for di National Judicial Council, if mata be as e get.

But sha wey Hon. Thomas Ereyitomi dey resin di whole drama, hin say di decision gud but di problem na di monie wey dem go dey spend.

“We get notice to tell us say di case from Delta don reach Lagos and we don follow. But na di kala be di koko but notin dey too big for pesin to get wetin hin dey find.”

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM