+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

President Ruto Tok Wetin Dey Mind Afta Tuesday Protest For Kenya

With di many protest wey don dey go on for Kenya cus of tax wey di govimet high, on Tuesday di story come change as five pesin die and many others karey wound go house and hospital.

Na like play di tin take start for small tok for social media bifor e enta street dey put pepper bodi for Kenya sotay dem even go burn di city hall, kontri parliament, and govinor office wey dey for di Capital, Nairobi.

But President William Ruto don tok say na jaguda nai take over di protest and he govimet nor go take am easy with any pesin wey wan cus gbege for di kontri.

He say wetin hapun on Tuesday he go make sure say e nor hapun again, cus na dem peace of mind nai nor dey at rest.

Di bill wey dey even cause all di problem na next week Monday dem wan pass am. Tax wey dem increase na for motor pipo, moni transaction, sanitary pad, health and other tins wey join.

As pipo don dey shout since di govimet don remove some of di tins wey dem increase afta dem sitdon tok with di public.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM