Di foma givinor of Anambra State, Peter Obi say di way accident take kill boxer Anthony Joshua close friends wey folow am come Nigeria, nor be good sign at.
Na on monday nai di foma heavy weight champion get accident for Lagos-Ibadan expressway road and authorities don say na over speeding nai make dem tire burst.
For twitter (X) nai Obi say di accident na call for Nigeria to resin demsef as no ambulance even dey to take rush Joshua go hospital.
Obi say na only prayer nai he fit give na and sorry to di close friends wey die, dem families, why President Bola Ahmed Tinubu don karey phone call Joshua, he mama according to Bayo Onanuga.
