+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

President Tinubu Don Land South Africa To Greet Ramaphosa

President Bola Ahmed Tinubu don land for South Africa to folow greet President Cyril Ramaphosa as he dey ready to enta seat again.

Di two of dem bin meet last on September 2023 for United Nations General Assembly and di leaders come run head togeda how dem relationship with di West African and South African kontri go fit go well.

But na on Tuesday evening nai President Tinubu land for Waterkloof Air Force Base wey dey for Pretoria, one of di busy place for South Africa.

As Ramaphosa dey tok with Tinubu, he say South African and Nigeria get one tin wey dem take resemble for politics, bilateral relationship and even how to make economic stand well.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM