+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

President Trump must change e mind for birth citizenship – Immigration Lawyers

‎Immigration lawyers don karey di new Presido wey just enta obodo USA , President Donald Trump go court cus of di law wey he remove say US nor go karey dey give citizenship to children.

‎On Monday, as Trump just enta position nai he sign say any man or woman wey come visit USA come born pikin that period dem nor go give di pikin citizenship or do pesin dey stay di kontri but nor get legal paper OYO nai go he di case of di pikin.

‎Dis Trump order don stop di birth right law wey don dey for ages and na in one month time dem go start to follow di law.

‎Na di tin make immigration lawyers say dem nor go sitdon allow Trump scatter dem law wey don dey for years, so Dem gada for New Hampshire on Monday evening to write di suit.

‎But for Trump side, he say he nor get shaking say di law he don put am and naso e go be

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM