+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Presido Tinubu Don Land Nigeria Afta Two Weeks Travel

Presido Bola Tinubu don las las come back from di two weeks travel wey hin go for Netherlands come pass enta Saudi Arabia.

Dem say na early mormor on Wednesday nai president take land for di presidential Villa inside Aso rock.

Bifor now, Bayo Onanuga, di Special Adviser on Information and Strategy, bin don tok on Tuesday say na Wednesday nai president and di pipo wey folow am go reach Nigeria.

How Presido movement start na afta di Prime Minister of Netherlands, Mark Rutte invite Presido Tinubu naso he take go visit di place, come still enta Saudi.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM