+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Presido Tinubu Sign Health Workers Policy To Drag Workers Come Nigeria

As everybodi dey japa from Nigeria to go find where soft even dokitors and nurses di tin don dey turn somehow cus to see medical pesin for hospital now don dey hard.

Cus di was wey tins take dey go nai make Presido Bola Tinubu come give him approval for National Policy on Health Workforce Migration so that dem fit get beta health workers for di kontri.

Na Prof Muhammad Pate, di Coordinating Minister of Health and Social Welfare nai open up di tori for X on Monday.

Dis policy na to return di way healthcare workers take dey japa komot Nigeria, manage di system well and even make Koret hand for obodo abroad come back to Nigeria to work.

Pate come say with di policy, na beta tins to take catch di eye for others wey dey abroad nai dey inside di pakage join with some other tins.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM