+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Primary 2 Student Dey Battle With Life Afta Teacher Beat Am For Skool

One teacher wey dey teach for Landmark Skool for Mgbakwu inside Awka for Anambra State don use beat karey one primary 2 student go land for hospital.

Di teacher wey her name na Faith Nwonye na 30 years while di student na 8 years and na for weekend di tin take hapun inside di skool.

According to wetin di Commissioner for Education, Prof. Ngozi Chuma-Udeh tok, di skool sef nor even dey register with govimet, and di pikin now dey for coma dey struggle to survive with wetin dokitors dem tok.

Prof Chuma-Udeh say make be even only di pikin mata now as di skool still dey illegal dem don close am and e nor go open titilialia cus na bad tin for pesin to get skool for di state wey nor dey under govimet.

She come dey advise parents make dem dey karey dem children go skool wey dey under govimet register.

Right now di case dey with police and afta investigation na punishment dem go sama give teacher Faith according to wetin child law tok.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM