Di Prime Minister of Chad, Succés Masra don write letter say hin nor dey work again afta hin nor win di presidential election wey di kontri just do.
Masra loose to General Idriss Mahamat Deby Itno bifor dem know he don run enta Facebook say he nor fit work with di junta govimet.
Di foma Prime Minister nai karey second for di election wey dem don and even bifor di constitutional court call di result he don go announce hinsef as di winner of di election.
But on Wednesday nai Masra say he nor dey do again as he nor fit work with di transition president afta di election wey dem do.