Di fire wey dey burn for Regina Daniels and her husband, Senator Ned Nwoko haux nor ne like wetin wan quech today as every side just dey turn fuel put.
For long post wey Regina broda Sweezy, write for instgram, he say he nor like make Regina marry Ned bifor but as e hapun he get support and all di document wey dey tok about he sista age, hospital result and even marriage certificate na fake.
Sweezy say di marriage certificate na fake cus Reginal nor do court wedding and di voter’s card na for Ned haux for Idumuje-Ugboko nai dem take do am, cus di real certificate of Regina karey dem papa Ojeogwu, nor be Daniels.
He come still stand say na October 10 2001 nai dem born Regina but Ned with he yeye way dey always tok say kidney dey disturb am, dey hide use am take cus problem for di marriage.
Even di hospital wey dem say nai bring medical report of Regina, don say di result na fake.
