+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Rep Members Wan Create Warri State With Oda States

‎E don dey clear say fight dey for Warri to know who be di real owner of di city, while some don kukuma turn one part to Wado City, na all dis move make di House of Representatives Committee for planning say dem wan create new state and Warri State na one of dem.

‎Di House Constitution Review Committe nai say dem wan create new 31 states join to di 36 states wey don already bin dey and na di Deputy Speaker, Benjamin Kalu nai read am.

‎Di names of di new states na Okun State, Okura State, and Confluence State from Kogi; Benue Ala and Apa States from Benue; FCT State; Amana State from Adamawa; Katagum from Bauchi State; Savannah State from Borno; and Muri State from Taraba.

‎Odas na New Kaduna State and Gujarat State from Kaduna State; Tiga and Ari from Kano; Kainji from Kebbi State; Etiti and Orashi go be di 6th state for Southeast; Adada from Enugu; and Orlu and Aba from Southeast.

‎Then di remaining na Ogoja from Cross River, Warri from Delta, Ori and Obolo from Rivers, Torumbe from Ondo, Ibadan from Oyo, Lagoon from Lagos, and Ogun, Ijebu from Ogun, and Oke Ogun/Ijesha from Oyo/Ogun/Osun states.

‎Well di committee say dem go look into all but di proposal get to follow di write step of wetin Nigeria constitution tok bifor dem go reason am well.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM