+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Rep Step Down Motion To Reverse Change of Niger Delta Ministry

As Presido Bola Tinubu don change name of Ministry of Niger Delta Development to Ministry for Regional Development and come even change di ministers, House of Representatives come say dem go meet am to change he mind back.

Na PDP member Oboku Oforji from Bayelsa State nai first bring di mata up and everybodi come folow am but small time mata come change as di House say other tins don take over di event.

Di Speaker of di House, Abbas Tajudeen, say he meet President Tinubu last week nai Presido give assurance say South-South Development Commission Bill na still same tin as e go take care of di specific issues wey dey concern Niger Delta Region; so make dem kukuma forget di mata.

All di lawmakers come follow gree then even di House Leader, Julius Ihonvbere, APC, Edo, come say as dem convert d ministry that one nor mean say e go reduce Niger Delta Region but na only just to make am wide so that development go dey touch everywhere and other region too.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM