+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Ribadu Nor Vex Na Wrong Infor We Get– Kano Govimet Beg NSA Oga

As gbege dey hapun for who to be Kano State Emir, di State govimet don dey point hand give Nuhu Ribadu wey be Nigeria Security Adviser say he dey play kurukere waka cus he karey private jet give Aminu Ado Bayero wey dem stop as Emir to come back to Kano state.

But di NSA office and come say that one na big lie against dem and dem come say na court di case go waka reach to tok di truth.

But for press conference wey di Deputy Govinor of Kano State, Aminu Gwarzo do today Monday, nai di govinor take dey beg di NSA oga make he nor vex.

Di deputy Govinor say dem don see for paper how Ribadu take dey vex say he go karey mata to court, dem say na wetin dem hear nai make dem feel say Ribadu hand join di wahala for di state.

Dem come tell di govimet make dem nor vex cus even dem supirse say dem hear say na Ribadu nai put hand join to take bring Aminu Ado Bayero wey dem don pursue come back to di state.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM